Páginas

Monday, August 5, 2013

Neymar help Barca wicked Santos


by Temisan Okomi 03 August 2013, 12:47
Neymar na new Barcelona playa, and na so hin show Barca fan dem how tins go be, wen hin troway one kin pass wey Barca carri score, even tho hin no score any goal, as Barca bilala Brazil club, Santos, 8-kondo (na Neymar forma club be dat) for Joan Gamper Invitational Trophy (forget de big English, na ‘play play’ match e be) on Friday.
Neymar na jus 21 years old, and hin bin waka enta Barcelona las May. Na ontop bench he siddon wey match start, but he enta match for second haf, come lay pass wey Cesc Fabregas take score hin second goal, bifor de guyman faya one helele shot wey nearly break goal post, as match enta mortuary time.
Na Lionel Messi start de whole gbege for Santos, wen hin faya shot enta net as match jus reach eight minit, and hin bin dey fild for second haf, wen Neymar enta, but na onli 15 minit hin play bifor coachi change am. E no mean sha, as Barca fans dem go don see how de two of dem go play dis new season.
As if wahala no do Santos, dia own defenda, Leo, come score for hin own net as match reach 12 minit, bifor Alexis Sanchez faya shot enta net for 22 minit to make am 3-kondo. Pedro sef come score as match reach 28 minit.
Spain midfilda, Fabregas, enta match for second haf, and de guyman resembu persin wey dey vex, and na so he score two goal to make am 6-kondo, bifor he waya one kin free kick nack post. Adriano and Barca smallie, Jean Marie Dongou come kukuma finish de work wit dia own goal.
De new season for Spain go start nes two weeks, and Barca (na dem be league champion) go start dia waka, wen dem go follow Levante play for house.